Integrity Score 1170
No Records Found
No Records Found
Wen man do wetin dem call foreplay before sex, im partner dey likely dey wet to show say her body dey ready.
Di woman estrogen level go come increase to make di knacking sweet for both of dem.
But some times and for some women, no mata wetin di man do, di woman vagina go dey dry.
Dis dryness fit make sex painful or no sweet at all, sake of dis some women dey avoid sex.
So many women and men don dey wonder wetin dey make woman vaginal dey dry even afta foreplay to make her wet?
See 2022 public holidays inside Nigeria
According to one gynaecologist, Dr Joseph Akinde some factors fit make woman vagina to dey dry during sex.
Dem include physiological factors like infection or medication for treating disease psychological factors like mood, stress, absent of ovulation and odas.
Dr Akinde wey be Medical Director of LivingSpring Hospital, Ejigbo Lagos, explain say vaginal infections fit cause vaginal dryness.
E also explain say drugs for treating mental health problems, for treatment of cancer, fibroid and endometriosis fit make woman vagina dry.
•Mood swings•
Woman state of mind fit determine weda she go get wet during kerewa or not.
"Woman fit dey vex and no dey in di mood for sex but accept to sleep with her husband to fulfil all righteousness fit no get wet."
•Lack of bedmatic skills•
Some experts say for some cases, some men no know how or where to touch dia woman before sex to get dem wet
Or some men dey in a hurry to get down sotey dem no dey prepare dia women enough to get wet before di real deal.
•Stress/Fatigue•
Concerning how tiredness fit contribute to vaginal dryness, Dr Akinde tok say;
"Woman wey dey tired on top say she just come back from work or dey traffic jam for hours, all dis fit make her not to dey di mood for sex."
Read more- https://www.bbc.com/pidgin/world-59872142.amp